Эпизоды
-
Wetin law talk about Mr & Mrs on top document property between two people.
-
Пропущенные эпизоды?
-
We go talk the meaning of Next of Kin under the Nigerian Law. Wetin e be and wetin e nor be.
-
I go tell Una wetin to do if person from court give you document/hearing notice from court.
-
On top this our first talk talk on our podcast, we dey explain wetin lawyas dey do, some people believe sai na only when police arrest person na him he need lawyer. We dey explain other things wey lawya dey do.
-
On top this episode I talk about the kind Notice to quit wey dey Tenancy Law for 9ja and how Landlord fit carry Tenant wey nor wan pay rent money comot for him house.
-
For this episode, we go dey talk about the law wey that guide Landlord and Tenant relationship for 9ja. Who be landlord and tenant, wetin be their responsibilities to each other? How landlord go handle tenant wey no wan pay rent.
-
Today, dem dey celebrate the girl every where for the world. On top this episode, we dey talk about things wey dey happen to our girls wey the law no agree with for Nigeria.
-
On top this episode, PidginLawya enter street, to ask pipo if dem feel sai lawyers dey important. We go like to hear from Una too. Una fit send Una response to our Facebook page @pidginlawya.
-
E good make we get agreement when we dey do business with our business partner.
-
We go dey talk about right of person wey dem arrest carry go police station. The things wey the person get right to do or ask for police station. We give credit for the material wey we use this episode to @NigLegalView.
-
We dey wish all our fine listeners bokuboku good things as we enter the second half of 2021.
-
For this episode, our host na Esther Ekong. She go dey talk the Court of Appeal and d kind mata wey dem get power to do.
-
On top dis episode, we do dey talk about the Federal High Court and the National Industrial Court. I go tell Una all di mata wey the courts dey do. Dis episode dey for two parts. The first one na about Federal High Court and the second one na National Industrial Court.
-
The Mata about rape don plenti for the world, no be only for 9ja. As na men dey do this rape, e good make dem follow women fight against rapist for our society. If men know another man wey dey rape, report that person to police. This mata dey affect all us for our society. Make we be our sister's keeper.
-
For this episode we go continue our talk on the different matter wey court dey handle. Today we go dey talk about High Court. I go explain for surface d kind Mata wey High Court dey do.
-
On this episode we continue with our talk on the different courts wey dey our country. Today I go dey explain the Mata wey customary/area and Magistrate court fit do.
-
Today, we go dey list all the courts wey dey 9ja. For our other episodes we explain all the matter wey each court fit do.
-
Welcome to our podcast, PidginLawya. Here we go break down all di plenti grammar wey lawyas dey talk. And all the law for our countri, we explain am well well, so una go understand.